For dat time, sweet wine go dey pour like rain from di mountins and di hill go flow with milk. Wota go dey evriwhere Judah, but river go from God temple rush go wet Shittim Valley.
“I dey baptize una with wota make una for turn from sin kom meet God, but di pesin wey go kom afta, strong pass mi. I nor big rish to luz di rope wey dey en shoe, na-im go baptize una with Holy Spirit and fire.
John ansa dem, “Na ordinary wota I take dey baptize una, but di pesin wey big pass mi, dey kom, I nor rish who go luz di rope wey dey en shoe. E go baptize una with di Holy Spirit and fire.
I nor know am before, but di pesin wey send mi kom baptize with wota tell mi sey, ‘Di pesin wey yu go si God Spirit kom stay on-top en head, na-im go baptize pipol with Holy Spirit.’
Paul kon tell dem, “John baptize pipol wey turn from sin kom meet God with wota kon tell dem make dem bilive di pesin wey go kom afta am and na dat pesin, bi Jesus Christ.”
Some pipol among us na Jew and odas na Gentile. Some na slave and odas dey free. But God Spirit baptize us kon make us part for Jesus Christ body. Naw, all of us dey drink from dat same Spirit.
E kon save us. Nor bi bikos wi do good, but na bikos of en mesi. E forgive awa sins and E make us new shidren kon give us new life thru di Holy Spirit.