25 so dat e go take Apostle Judas, wey kill ensef, place.”
Wen en kase don rish to judge, make dem sey na-im dey wrong. Make God si en prayers as sin.
“Di king go tell di pipol wey dey en left hand, ‘Make una komot from my side, una wey God don curse! Make una enter hell-fire wey dem prepare for devil and en wiked angels.
“So wiked pipol go enter ponishment wey nor go end, but raitious pipol go get life wey nor go end too.”
Man Pikin go die as dem rite about am, but curse dey di pesin head wey go sell am! E for betta sey dem nor born di pesin at-all.”
Afta Judas take di bread, devil enter en mind. Jesus kon tell am, “Di tin wey yu won do, make yu go do am kwik-kwik.”
Wen I dey with dem, I keep dem with yor name. No one lost, escept di one wey yor word sey e go perish.
Na thru am, God give us favor and pawa to bi apostles and na dis pawa wi dey use take dey koll Gentile pipol, make dem obey and bilive en name.
If I nor bi apostle to oda pipol, at least I bi apostle to una, bikos na una bi di sign wey show sey I bi Jesus Christ apostle.
(Bikos na thru God pawa Pita take prish to Jew pipol and na di same pawa I take dey prish give Gentile pipol too),