Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




3 John 1:8 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

8 So wi suppose to help doz pipol, so dat wi go bi dia ko-worker wey go make di trut stand.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




3 John 1:8
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Naw, who go protet mi from wiked pipol? Who go help mi fight doz wey dey do evil?


If di pipol nor welkom or listin to una message, make una shake dia san komot from una leg as una dey leave dat house or town.


“Pesin wey welkom yu, welkom mi too and anybody wey welkom mi, welkom di Pesin wey send mi.


“Den yor friend kon ansa from inside house, ‘Make yu nor disturb mi. I don lock my door and mi and my shidren dey sleep. I nor go fit get up give yu anytin naw.’


Naw, bikos wi bi fellow workers, wi dey beg una make una nor waste God grace wey una don receive.


But for Titus, en na my patina and e dey follow mi work to help una. As for di oda brodas wey dey follow am, na all di church sey make dem kom meet una, so dat dem go tell una about di glory wey dey inside Christ.


Yes, my good friends, I still dey tell una, make una help dem. Dem try as dem dey prish di gospel with mi, both Klement and my oda ko-workers, wey dia name dey inside Christ Life Book.


Jesus wey dem still dey koll Justus, dey greet una. Jew pipol wey bi Christian and dey follow mi do God work, na only dem dey help mi.


So wi kon send Timoti, awa broda wey dey follow us do God work sey, make e kom enkourage una koncerning una faith,


And to Afia awa sista, Arkippus awa fellow soja and di church pipol wey dey meet for en house.


Mark, Aristakus, Demas and Luke, wey bi my ko-workers, dey greet yu too.


So, wen I kom, I go tell evribody wetin e do; tins wey wi nor do and e sey wi do am. Even doh e dey tok bad about us, dat one nor do for am; nor bi only sey e nor dey welkom awa brodas, but e dey make odas nor welkom dem too and e dey drive dem komot from di church.


Dem start dia journey bikos of “Christ name” and dem nor gri take anytin from pipol wey nor bi Christian.


I bin rite leta to di church pipol, but Diotrefes, wey dey karry body up sey na-im bi dia leader, nor gri welkom us.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ