7 Dem start dia journey bikos of “Christ name” and dem nor gri take anytin from pipol wey nor bi Christian.
Since dem nor know di Pesin wey send mi kom, dem go do all dis tins to una bikos of my name.
Since una know mi, I nor put eye for anybody gold, silva or koat.
Like dis, I don show una sey wi must help pipol wey dey weak and una remember wetin Jesus Christ tok, wen e sey, ‘E betta make pesin dey give pipol tins, dan make e dey kollect from dem.’ ”
So di apostles komot from der dey happy well-well sey God don give dem di shance to sofa, bikos of Jesus Christ.
So di pipol wey skata kon dey go from place to place dey prish di gospel.
True-true I go show am how e go sofa, bikos of my name.”
Wetin kon bi my gain? Na to prish di gospel without pay or na to use di rite wey I get, bikos I dey prish di gospel?
Bikos di way wey dem trit us worse pass di oda church, escept sey I nor dey put my load for una head. Make una forgive mi for dis tins wey I do!
Wi nor dey tok about awasef, but wi dey prish sey, na Jesus Christ bi Oga God and wi bi una slave, bikos of am.
Bikos of dis, God raiz am up kon gi-am di name wey big pass evry oda name,
I dey happy for di sofa wey I dey sofa for una and for di church wey bi Christ body, so I dey take my body komplete wetin remain for Christ sofa.
So wi suppose to help doz pipol, so dat wi go bi dia ko-worker wey go make di trut stand.
I still know sey yu don bear many tins bikos of my name and still, yu neva taya.