Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




3 John 1:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 So, wen I kom, I go tell evribody wetin e do; tins wey wi nor do and e sey wi do am. Even doh e dey tok bad about us, dat one nor do for am; nor bi only sey e nor dey welkom awa brodas, but e dey make odas nor welkom dem too and e dey drive dem komot from di church.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




3 John 1:10
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Pesin wey dey hide di trut dey kause trobol, but pesin wey dey tok am for publik, dey work for peace.


Pipol wey get sense dey happy well-well wen dem advise dem, but foolish pipol words go distroy dem.


Make una listin to wetin God tok, “Una own pipol hate and porshu una bikos una dey obey my name. Dem dey laf una sey ‘Oya! Make una honor God name na! Make belle sweet una na!’ ” But make una nor worry, bikos na dem go shame.


Una wey pipol hate, rijet, curse and dey koll bad pipol bikos of Man Pikin, God go bless una


(En papa and mama tok like dis, bikos dem dey fear di Jew oga dem wey don tok sey, “Anybody wey tok sey na Jesus bi di Christ, dem go drive am komot from di sinagog.”


Di pipol wey dey pray, plenty rish one hundred and twenty. So Pita stand up for di pipol front kon sey,


Wen I dey with una for my sekond visit, I tell una wey dey sin before about dis tins. Even doh I nor dey with una naw, I dey tok am again sey, if I kom again, I nor go sorry for anybody, but I go ponish am,


So anytime wey wi get shance, make wi dey do good, especially to pipol wey bi God shidren.


For di same time, dem go dey lazy, dey waka from house to house, dey do aproko and tok anyhow.


If anybody kom meet una and e nor asept wetin wi dey tish, make una nor welkom or receive am as una broda.


Even doh I get many oda tins wey I won tell una, I nor won take paper and biro rite dem, but I hope sey I go kom visit una and I go tok to una face-to-face, so dat awa happiness go full.


I happy well-well wen awa brodas kom tok about how yu dey always live for di trut.


My friend, di tins wey yu dey do for awa brodas wey yu nor even know, good well-well.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ