20 Erastus dey for Korint and bikos Trofimus nor well, I kon leave am for Miletus.
Afta dis tins, Paul komot from Atens go Korint.
Krispus, di oga for di sinagog and en family, plus many Korint pipol wey hear about Jesus Christ, bilive and dem kon baptize dem.
So, afta e send two men wey dey help am, Timoti and Erastus go Masidonia, e kon still stay Asia small.
From der, wi move and di next day, wi kon rish Miletus.
From Miletus, e send messenja go Efesus sey make di eldas wey dey di church kon meet am der.
Pipol wey follow Paul go, na Sopata, wey bi Pyrrhus pikin wey kom from Berea; Aristakus and Sekundus wey kom from Tesalonika; Gaius from Derbe; Timoti with Tikikus and Trofimus wey kom from Asia.
(Bikos dem si Trofimus wey kom from Efesus for di town with am before, so dem kon tink sey, Paul don karry am enter di temple.)
Gaius, wey dey kare for mi and di church, dey greet una. Erastus wey bi di town treasurer and awa broda Kwartus, dey greet una.