11 Na only Luke dey with mi. Make yu karry Mark follow body wen yu dey kom, bikos e go fit help mi for di ministry work.
So God ansa, “I go bring my pipol kom back to mi. I go love dem with all my heart and I nor go vex for dem again.
So many pipol wey bi first naw, go bi last and doz wey bi last, go bi first.”
“So, di pesin wey bi last, go bi first and di first, go bi last.”
Den doz wey bi last, go bi first and doz wey bi first, go bi last.”
Wen Pita eye don klear, e kon waka face Mary house wey bi John Mark mama, where many pipol gada dey pray for am.
Banabas and Saul kon go back to Jerusalem wen dem don finish dia work and dem take John Mark follow body.
Banabas won kon karry John Mark follow body,
Dis matter kon kause sirious kworel, sotey dem kon separate. Banabas take Mark follow body and dem kon enter ship go Cyprus,
Wen Paul si dis vishon finish, wi kon try to go Masidonia. Wi kon bilive sey God don koll us make wi go prish di Good News to di pipol wey dey der.
Aristakus, wey follow mi dey prison dey greet una and Mark wey bi Banabas kousin (wey wi bin tell una sey, if e kom meet una, make una welkom am) dey greet una too.
Awa friend Demas and Luke, wey wi love well-well, wey bi doctor, dey greet una too.
Yu know sey evribody for Asia, Figelus and Hermogenes aria, don run leave mi.
So if yu keep yorsef without fault, yu go bi betta pesin wey Christ fit use as e dey do en good work.
Mark, Aristakus, Demas and Luke, wey bi my ko-workers, dey greet yu too.
God pipol for di church wey dey Babilon dey greet una and Mark, my pikin, dey greet una too.