Anybody wey tok bad against Man Pikin, God go forgi-am. But anybody wey tok bad against di Holy Spirit, God nor go ever forgi-am, weda for dis life or di one wey dey kom.”
“No savant go fit serve two oga, bikos e must hate one kon love di oda one, or e go serve one with all en body dan di oda one. So, yu nor go fit serve God and money for di same time.”
Dis Jew pipol get betta mind pass di ones wey dey for Tesalonika, bikos dem open mind take bilive di message and dem dey read God word evriday to shek weda all di tins wey dem hear, na true.
But for Titus, en na my patina and e dey follow mi work to help una. As for di oda brodas wey dey follow am, na all di church sey make dem kom meet una, so dat dem go tell una about di glory wey dey inside Christ.
Pesin wey love money, go get wahala, wiked and evil tins. Bikos some pipol one get money by force, dem don fall komot from di faith kon wound demsef anyhow.
Make yu give dis kommand to rish pipol. Tell dem sey, make dem nor dey karry body up kon dey trust dia money wey nor get value and make dem dey trust God wey dey give us evritin wey wi nid to take enjoy dis life.