9 But dem nor go do am tey, bikos evribody go si how dem foolish rish, just as e happen to Jannes and Jambres.
Mikaya ansa, “Yu go know di trut, wen yu go-go back of yor house go hide.”
True-true, di way Yu dey vex judge human being, go make dem praiz Yu. Yu really dey show as Yu dey vex rish.
Fero sef tell en native doctors and juju-men for Egypt sey make dem do di same tin.
All of dem trow dia stik for groun and dia stik turn to plenty snake. But Aaron stik swallow all di oda stiks.
Di juju-men nor fit stand for where Moses dey, bikos of di boil wey full dia body and Egypt pipol own.
Wetin happen to yor profets wey sey Babilon king nor go attack yu or dis town?
But di Farisee pipol and di law tishas kon vex sotey dem nor dey si road again, so dem kon bigin ask diasef, “Wetin wi go do Jesus Christ.”
Naw, God don raiz en hand against yu. Yor eye go blind and yu nor go fit si for sometaim!” At wons, e eye just blind and darkness kover en face and e kon dey take hand find pipol make dem show am road.
Just as Jannes and Jambres oppoz Moses; na so too, dis pipol wey dia mind block and nor get faith, dey oppoz di trut.