Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Timoti 3:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 If yu look dem well-well, dem bi like God pipol, but dem don rijet God pawa. So make yu run from dis kind pipol.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Timoti 3:5
20 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

God sey, “Dis pipol sey dem dey obey mi, dem dey tok good-good tins about mi, but dem nor really dey respet mi and evritin wey dem tok nor rish dia heart. Dia relijon na law and tradishon wey human being make with dia own hand.


“Make yu shine yor eye, bikos lie-lie profets go kom like sheep, but for inside dia heart, dem bi wiked animal wey dey kill.


So make wi nor bi like shidren wey breeze dey karry up-and-down; shidren wey dey follow yeye tins wey human being dey tish and na dis tins dem dey take deceive pipol.


But if anybody nor obey awa message thru dis leta, make una look dat kind pesin well-well and make nobody follow am waka or do anytin togeda, so dat shame go katch am.


My brodas and sistas, wi dey kommand una with awa Oga God Jesus Christ name sey, make una nor follow bilivers wey dey do anyhow and nor dey do as wi tell dem.


But make una rijet lie-lie and yeye story. Instead make una dey train unasef with betta words from God.


Fisical trainin dey good, but na to know God good pass, bikos yu go get reward for dis life and di one wey dey kom.


But if anybody nor fit kare for en pipol, especially en family membas, e don deny di faith bi dat and e worse pass sina.


and wahala, naim e dey kause. Dia mind don spoil and dem nor know di trut again, bikos dem tink sey dem fit use God work take make money.


Make yu nor put mout for yeye tok, bikos pipol wey dey do doz tins, dey far from God.


I dey tell yu again sey, make yu nor put mout for yeye word, bikos yu know sey dis kind tin dey kause kworel.


Dis kind pipol dey sey dem know God, but di way wey dem dey live dia life, show sey dem nor know am, bikos dem get bad mind, dey disobey God and dem nor ever dey like betta tin.


If anybody dey won kause kworel for di church and yu don warn am rish two times and e nor gri shange, den make yu drive am.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ