I curse dia wiked mind, bikos e too strong and dia annoyance, bikos e dey bad well-well. I go divide dem inside Jakob family kon skata dem among Israel pipol!
Doz wey bin dey opress una, dia sons go kom bow for una. All di pipol wey look down on una before, go kon woship una. Dem go koll una, ‘Oga God Town. Zion, di town wey Israel God wey dey holy dey stay.’
Wetin full dia mind na wikedness, evil tins, long-trot, bad belle, bad-bad tins; jealousy, to kill and fight, to lie, to keep enemy with pipol, to judge pipol waka,
Make una nor refuse each oda, escept una gri sey una go dey like dat for sometaim, so dat una go fit pray. Den Satan nor go fit tempt una, bikos una go fit kontrol una body.
Instead make e dey welkom strenjas for en house; love wetin dey good and e must get sense; make e nor dey put hand for bad tin; e must dey holy and fit kontrol ensef.
Make yu tish old wimen sey, make dem live life wey go make God happy. Make dem nor tok bad about pipol; nor dey drink anyhow, instead make dem tish oda wimen wetin dey good.
Wetin dem like pass, na to sleep with who dem nor marry; dem nor dey taya to sin and dem dey draw doz wey dia faith nor strong, follow body. Dem don train dia mind to get long-trot and God don curse dem.
Even doh dis fake tishas dey promise dis pipol sey, dem go dey free, di fake tisha na slave dem bi to sin. Bikos pesin na slave to anytin wey masta am.
Dis pipol dey komplain waka and dey find fault. Dem dey go anywhere wey dia body karry dem go and dem dey boast. Dem dey tok wetin pipol like to hear, so dat odas go praiz dem.
God pipol wey dem kill and doz wey prish about Christ, I si di woman wen e dey drink dia blood and di blood dey shark am like wine. I sopraiz well-well wen I si di woman.