Wetin I wont bi sey, wen una don really undastand God sekret wey dey inside Jesus Christ, make una heart dey strong with love, so dat una go get evritin wey una wont.
Nor bi only thru ordinary word wi take prish di gospel give una, but na with di Holy Spirit pawa and wi show sey, evritin wey e tok, na true. Una know how wi dey live and help una.
Wi still dey tank God evritime, bikos wen una asept God message wey una hear from us, una nor asept am like sey na human being message, but una asept am as God message and true-true na God message e bi and God dey work inside una wey don bilive.
Make yu wosh as yu dey live yor life and di tins wey yu dey tish. Get patient, bikos if yu dey do like dis, yu go save yorsef and doz wey dey listin to yu.