di Angel wey don protet mi from all wahala, bless dis boys. My name and my papa Abraham and Isaak name go shine for dia life. Dia shidren go many like san-san for dis eart.”
So make una nor fear, bikos I dey with una! Na mi bi una God, so make anytin nor make una fear! I go make una strong kon help una and I go protet and save una.
God sey, “Israel pipol, as una small and dey weak rish, make una nor fear, bikos I go help una. Mi wey bi Israel God wey dey holy, na mi bi di only Pesin wey go save una.
Wen una dey pass thru deep wota, I go dey with una. Una go fit handle any wahala wey kom una way. Wen una pass thru fire, e nor go burn una. Di temptashon wey go kom, nor go too hard for una.
Wen di argument kon too mush and di kommanding offisa dey fear sey dem go tear Paul to pieces, e kon orda en sojas make dem enter di meetin and karry Paul komot for der by force.
But God don dey help mi till today, so I stand dey tell evribody, weda dem bi small pikin or big pesin. So, wetin di profets and Moses tok sey go happen, naim I dey tell una so,
I dey happy as I dey weak with all di curse, trobols, ponishment and wahala wey I dey sofa bikos of Christ, bikos anytime wey I dey weak, na dat time, I dey-dey strong.