Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Timoti 2:9 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

9 and na dis Good News make mi dey sofa, sotey dem kon put mi for prison like tif; but dem nor fit put God word for prison!

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Timoti 2:9
22 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Dem still take two oda men wey bi tif, wey dem wont kill, follow Jesus.


Den di kommanding offisa arrest am kon give orda sey make dem tie am with two shain. E ask am who e bi and wetin e do.


kon dey tell dem about God Kingdom. E tish dem with strong heart about Oga God Jesus Christ and nobody fit stop am.


True-true I go show am how e go sofa, bikos of my name.”


Bikos of dis, mi Paul wey bi prisona for Christ, bikos of una wey bi Gentile pipol, dey pray give God.


Doz oda ones wey dey prish about Christ dey do so, bikos dem dey tink about diasef and wetin dem go gain. Dem nor dey do tins with klean mind and dem tink sey dem fit kause more trobol for mi, bikos I dey prison.


So e dey good for mi to dey tink about una like dis, bikos una dey my heart. Una don follow mi share from God favor, even wen I dey prison and wen I dey prish di trut about di gospel.


Mi Paul, dey rite dis greetin with my own hand. Make una remember di shains wey dem take tie mi and make God grace dey with una.


Like dis too, make una dey pray for us, so dat God go give us betta shance to tok about Christ sekret, wey make mi dey prison.


Bikos nor bi only sey di message about Christ don rish evriwhere for Masidonia and Akaia, but dem don hear di news about una faith for evriwhere. So wi nor even nid to tok about una again.


Finally, my brodas and sistas, make una pray for us, so dat Christ message go kontinue to spread kon get glory just as e really get among una.


And naim make mi dey sofa wetin I dey sofa so. But I nor dey shame, bikos I know di Pesin wey I dey serve and I dey sure sey, E go guide di tin wey I gi-am whole, until di day wey Christ go kom.


Make God show en mesi to Onesiforus family, bikos e dey always make mi happy and e nor dey shame sey I dey prison.


So make yu dey proud to tok about Christ or about mi wey dey prison bikos of am and make yu use di pawa wey God give yu, take follow mi sofa for dis gospel.


Make yu dey ready to sofa as mi and odas dey sofa, so dat yu go bi good soja for Christ.


But God dey for my side and E give mi pawa, so dat thru mi, Gentile pipol go hear di Good News and Christ don save mi from lion mout!


So make una dey live well among pipol wey nor bi Christian, so dat wen dem sey una do bad, dem go si di good tins wey una dey do and dem go praiz God wen E won judge di world.


or govnors wey God choose sey, make dem ponish pipol wey do bad and praiz doz wey do good.


But make una do am with gentolness and respet, dey make sure sey una mind klean, so dat pipol wey dey tok bad about di good tins wey una dey do for Christ, go shame for di bad wey dem dey tok.


But make anybody among una nor sofa, bikos e kill, tif or curse trobol.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ