Di seeds wey fall for shuku-shuku, na di pipol wey hear God word, but wahala, plenty propaty and jolly-jolly for dis world kon shuk dem, so di fruit nor even ripe.
but na God choose us to prish di gospel and na so wi dey prish am. Wi nor dey do am make pipol for praiz us, but make God wey dey si awa heart, praiz us by ensef.
Afta dem don free from sin thru awa Oga God and Savior Jesus Christ and dem kon let sin masta dem again, dia kondishon for di end, go worse pass as e bi before.