Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Timoti 1:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 Na dis make mi dey remind yu sey, make yu dey use God gift wey yu get well and yu receive dis gift afta I lay hand for yor head.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Timoti 1:6
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

And di wimen wey dia mind move dem kon weave all di goat hair to wool.


Den Moses tell Bezalel, Oholiab and evribody wey get handwork wey God don give wisdom and wey get mind to work sey, “Make una bigin work.”


Make una remind mi of di good wey una do; make wi tok di matter togeda; make una tok as una take good.


Before e go, e koll ten of en savant kon give each one money sey, ‘Make una take dis money trade and make profit till I kom back.’


and as Paul put hand for dia head, di Holy Spirit enter dem and dem kon start to speak difren language, dey profesai.


Dem show dem to di apostles. Di apostles put hand for dia head kon pray for dem.


Make una nor drive God Spirit komot for una life.


Nor stop to dey use di spiritual gift wey yu get; bikos yu get am thru profesy, wen eldas put hand for yor head dey pray.


If yu give all dis kommand to di brodas and sistas, yu go bi good savant for Christ, bikos yu don feed yorsef with God word, wey bi di spiritual food and naim bi di good tishing wey yu dey follow.


Make yu remind evribody about dis tins, den make yu kommand dem for God present sey, make dem nor dey argue about words, bikos doz kind tins nor dey good and e fit konfuse doz wey dey listin.


Make yu dey prish God word and dey ready, weda di time dey okay or not. Make yu use patient take korrect and enkourage yor pipol with betta tishing.


wetin baptizim mean; to put hand for pipol head; to wake pipol from deat and about God final judgement.


I go dey remind una dis tins evritime, even doh I know sey una know dem and naw, una leg don strong for di trut wey una bilive.


My friends, dis na di sekond leta wey I dey rite to una, so dat una go dey tink about di tins wey I tell una.


So I won remind una even doh una don already know dis tins. Afta God don first save Israel pipol from Egypt, e kon distroy doz wey nor bilive am.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ