3 Anytime I remember yu for my prayer, weda na for nite or day time, I dey always tank God wey I dey serve with betta mind, just as my grand-grand papa dem serve am.
“I bi Jew wey dem born for Tarsus wey dey Silisia, but na for dis town I for grow, I go skool and learn awa grand-grand papa dem law well-well under Gamaliel and I get mind to serve God well-well, just as una bi today.
But I go let yu know sey I dey woship di God wey awa grand-grand papa dem dey woship, as dia tradishon tok (wey dis pipol sey na one kind gang). Dem bilive evritin wey di law tok and wey di profets rite down.
Wi dey happy, bikos wi know sey di way wi dey live awa life for dis world and how wi dey bihave with una, dey show sey na God send us thru en pawa, nor bi human being own.