11 Wi hear sey some pipol among una dey leave anyhow and dem nor dey mind dia business, instead dem dey put eye for anoda pesin tin.
Pesin wey dey tif, make e nor tif again. Instead, make e work hard and do good with en own hand, so dat e go fit give pipol wey nor get.
Make una dey do well, so dat una go live kwayet life; dey mind una own business and dey work with una hand as wi kommand una before.
My brodas and sistas, wi dey kommand una with awa Oga God Jesus Christ name sey, make una nor follow bilivers wey dey do anyhow and nor dey do as wi tell dem.
For di same time, dem go dey lazy, dey waka from house to house, dey do aproko and tok anyhow.
But make anybody among una nor sofa, bikos e kill, tif or curse trobol.