12 Den God go distroy dem, bikos dem enjoy sin instead of di trut.
God dey si both good and bad pipol. E hate doz wey love wahala.
Di pipol dey deceive di king and en ofisas with all dia evil plans and di prince dem dey make di king happy with dia lie-lie words.
but na una even hate good tins kon love wiked tins. Una dey kill my pipol alive kon kut dia flesh from dia bone.
Wen dem hear am, dem happy well-well kon promise am money. So, Judas kon bigin find how e go fit take sell Jesus give dem.
Anybody wey bilive and dem baptize am, God go save am, but anybody wey nor bilive, God go kondemn am.
Pesin wey bilive di only pikin wey God get, go get life wey nor dey end. But pesin wey nor bilive Man Pikin, nor go get life at-all. God go always dey vex with dat kind pesin.”
Aldo dem know sey God law sey, pipol wey dey live like dat go die, yet dem nor only dey do dis tins, but dem even dey support pipol wey dey do am.
Make wi love each oda well-well. Make una hate anytin wey dey bad, but una must love anytin wey get trut.
But E go show en vexnashon and ponish doz wey bikos of long-trot rijet di trut kon dey do bad tins.
E nor dey happy with wiked pipol, but e dey happy with di trut.
I go revensh and pay dem back wen dem go fall, bikos di day wen wahala go kom meet dem, don near well-well and dia judgement don almost full!”
Bikos God nor choose us to sofa en vexnashon, but to get salvashon thru awa Oga God Jesus Christ
E go use wayo deceive doz wey go perish, bikos dem nor won love and respet di trut wey for save dem.
and dis tishas go deceive una with dia wayo. God don kondemn dem tey-tey and Christ wey go distroy dem, nor dey sleep.
My friend, make yu nor follow bad tin, but do wetin dey good. Di pesin wey dey do good, na God own and di pesin wey dey do wetin bad, neva know God.