Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Tesalonians 2:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 So God go make dem deceive dis pipol well-well and dem go bilive dia lie-lie.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Tesalonians 2:11
21 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

As di oga hear di word wey en wife tell am sey, “Dis na how yor savant trit mi,” e kon dey vex for Josef.


E love to curse odas. Naw, make Yu curse am. E nor dey ever bless odas; so naw, make Yu nor bless am.


E just bi like sey dem dey chop ashes. Di foolish tins wey dem dey tink don deceive dem and dem nor fit help demsef again or tell demsef sey, ‘Nor bi lie-lie God wi dey serve so?’ ”


So, I go bring wahala and di tins wey dem dey fear, bikos wen I koll, nobody ansa and wen I dey tok to dem, nobody gri listin to mi. Evritin wey dem do dey make mi vex and dia ways nor bi my ways.”


Make una nor listin to doz wey dey deceive una, bikos dis tin fit make dem karry una far; go where una nor know. I go drive una komot from una land and una go die for der.


Den I sey, “God wey get pawa, wetin make Yu deceive Jerusalem pipol? Yu bin sey peace go dey, but naw, Yu dey ready to kill.


“If any profet give una wrong massage, make una know sey na mi wey bi God do am like dat. But I go still rijet and remove am from among my pipol for Israel.


Di vishons wey una si nor bi true and wetin una sey go happen, na lie. Una dey evil and wiked well-well and una day dey kom; di day wey God go ponish una, den di swod go kut una neck komot.


Many wayo profets go kom and dem go deceive many pipol.


Many pipol go kom with my name dey sey, ‘I bi Christ wey bi di Mezaya’ and dem go deceive many pipol.


Since dem nor gri put God for mind and serve am, E kon leave dem make dem use dia bad mind dey do tins wey dem nor suppose do.


Bikos wetin wi dey prish nor bi with mistake, dirty mind or wayo,


Di Spirit tok sey for di last days, some pipol go leave di faith kon dey bilive lie-lie spirits and follow wetin demons dey tish.


Dem go rijet di trut and love lie-lie story.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ