Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Tesalonians 1:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 e go drive sinnas komot from en present, en pawa and en glory. Dat day, evribody wey bilive, go praiz am and true-true, una bilive evritin wey wi tell una.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Tesalonians 1:10
40 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

God dey pawaful as E dey kom from en temple. Israel God dey give pawa and strent to en pipol. So make all praiz bi en own!


Even angels dey honor am wen dem gada togeda and E great pass evribody wey dey round en throne.


Di day dey kom wen God go honbol proud pipol kon disgrace sturbon pipol. Den na only God, pipol go dey praiz.


Na mi form dis pipol for mysef and dem go sing praiz mi!”


Heavens, make una shaut dey happy! All di deep part for dis eart, make una shaut well-well! Make mountins and evry tree for di forest, shaut too, bikos God protet Israel pipol kon show how E great rish.


E tell mi sey, “Israel, yu bi my savant and pipol go praiz mi, bikos of yu.”


Una pipol go do di rite tin and dem go get di land forever. Na mi plant and make una, so dat evribody go know how I great rish.


Jerusalem go bring joy, honor and pride for mi and all di nashons for di world go fear wen dem hear about di good tins wey I go do for Jerusalem pipol and how I go make dia town prosper.”


Oga God sey, “Dem go bi my pipol. For di day wey I go kom judge di world, na dem go bi my own. I go sorry for dem, just as papa dey sorry for en pikin wey serve am.


Nobody fit curse Jakob shidren; majik nor fit wound Israel pipol. And pipol go tok about Jakob sey, ‘Si di wonderful tins wey God don do for Israel pipol!’


God Pikin and en angels go kom inside en Papa glory, den e go reward evribody akordin to dia work.


I tell una true word, some of una dey here wey nor go die, before God Pikin go kom back with en kingdom.”


“Nobody know dat day or di time, even di angels for heaven nor know am, escept my Papa.


“Wen Man Pikin and en angels go kom with en glory, e go sidan for en king throne.


For dat day wey God go judge evribody, many pipol go sey, ‘Oga God, wi use yor name prish God message, drive many demon komot from pipol body and do many mirakle.’


I tell una true word, e go betta for Sodom for judgement day pass dat town!


Wen Jesus hear di message, e kon sey, “Dis sickness nor go kill Lazarus. E go make God and en pikin get honor.”


Evritin wey I get, na yor own and evritin wey yu get, na my own and dem don honor mi.


make e know sey, God go espose en work, bikos E go test am with fire for Judgement Day. Di fire go test di work wey evribody dey do.


so dat wi wey first bilive Christ, go dey gi-am praiz and glory.


God deposit dis Holy Spirit for di tins wey wi go inherit, until di time wen E go save en pipol, so dat all praiz and glory go bi en own.


Una eye don open to undastand di grace wey God koll una kom enter and una don si how di blessing wey E promise en pipol, plenty rish.


So, make all praiz and glory bi en own, bikos of en free grace wey E give us, thru en pikin wey E love well-well.


E do dis, to show evribody for di world wey dey kom sey, en grace wey dey show us kindness thru Jesus Christ, big well-well.


E make dem undastand, so dat thru di church, all di rulers and pawas wey dey heaven go kon know God komplete wisdom, wey dey show ensef for difren ways.


I dey pray sey as en glory big rish, E go make una strong well-well with pawa thru en Spirit wey bi di really pesin inside una.


Nor bi only thru ordinary word wi take prish di gospel give una, but na with di Holy Spirit pawa and wi show sey, evritin wey e tok, na true. Una know how wi dey live and help una.


Awa brodas and sistas, una know sey awa visit nor dey yuzles.


Wi dey advise, beg and tok to una sey, una must live una life as God wont, bikos na-im koll una enter en own kingdom and glory.


Wi still dey tank God evritime, bikos wen una asept God message wey una hear from us, una nor asept am like sey na human being message, but una asept am as God message and true-true na God message e bi and God dey work inside una wey don bilive.


So, bikos of una, pipol go dey praiz awa Oga God Jesus Christ and akordin to awa God and Oga God Jesus Christ grace, unasef go dey receive en blessing.


But my brodas and sistas wey God love, wi dey always tank God for una evritime, bikos God don choose una from di biginnin sey, E go save una with di Holy Spirit pawa wey go make una dey holy, since una get faith and trut.


Wi know sey God ways dey great well-well: Christ kom as human being; di Spirit show sey e dey free; angels si am wen e kom prish among Gentile pipol; pipol bilive am for di world and God karry am go heaven with glory.


And naim make mi dey sofa wetin I dey sofa so. But I nor dey shame, bikos I know di Pesin wey I dey serve and I dey sure sey, E go guide di tin wey I gi-am whole, until di day wey Christ go kom.


For di day wen Christ go kom, make e show am en mesi! And yu know how e help mi wen I dey Efesus.


Naw, di prize for raitiousness dey wait mi and na God wey dey judge rite go give mi dis prize for di day wen Christ go kom. Di prize nor bi for mi alone, but na for evribody wey dey wait for Christ to kom back.


But God don choose una to bi en priest and holy pipol, so dat una go prish di Good News, bikos E koll una from darkness kon enter en brite lite.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ