1 Na Paul, Silas and Timoti rite dis leta go give God and Jesus Christ pipol wey dey di church for Tesalonika.
So di apostles, eldas and di whole church kon gri sey dem go send some men follow Paul and Banabas go Antiok. Den choose Judas, wey dem dey koll Barsabas and Silas and dem bi leaders among di brodas.
Paul kon still go Derbe and Lystra. One disciple wey dem dey koll Timoti dey der. En mama na Jew wey bilive Christ, but en papa, na Greek.
Afta dem pass Amfipolis and Apollonia, dem kon rish Tesalonika where one Jew sinagog dey.
Bikos God Pikin, Jesus Christ, di One wey mi, Silas and Timoti dey prish give una, nor bi “Yes” and “No.” But from biginnin, na Jesus bi God “Yes.”