Den for di sevent year, Jehoiada wey bi di priest kon send message sey make dem koll di sojas and di guards oga kom meet am for di temple, where e for make kovenant and swear with dem. Den e show dem di king pikin
Jehoiada pikin Benaya wey kom from Kabzeel, na anoda strong soja. E still do many big tins kon kill two strong men for Moab. One day, e enter one pit go kill lion.
Curse dey Filistia pipol head wey dey near di river and doz wey dey Kanaan land, bikos dis judgement na against una two! God go distroy all of una finish.