12 E win Edom, Moab, Ammon, Filistia and Amalek pipol and e still karry tins from Hadadeza.
Joab tell am, “If yu si sey Siria sojas dey opress mi, make yu kom help mi and if Ammon sojas dey opress yu I go kom help yu.
So as Ammon sojas si sey Siria sojas dey run, dem too kon bigin run from Abishai enter di town. Den Joab kon go back to Jerusalem.
E win Moab pipol too. E make dem liedan for groun kon divide dem group by group and for evry three group, e kill two. So Moab pipol kon dey work and pay dia tax give David.
King David dedikate dis tins to God with di gold and silva wey e win from Edom, Moab, Ammon, Filistia and Amalek pipol.
E katch Agag, wey bi Amalek pipol king, but e kill all en pipol with swod.
Den David and en men kon go fight Geshur, Girz and Amalek pipol wey dey stay di land since. David kill dem from di town mout for Shur go rish Egypt.
But David kill dem from morning until di next evening. Non of dem eskape, escept di 400 men wey enter kamel kon run.
David take all di sheep kon put dem for di oda animals front. Pipol kon dey sey, “Dis na di tins wey David karry!”