Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Samuel 7:21 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

21 Bikos of yor promise and as Yu wont am, na-im Yu take do dis tins kon show mi wey bi yor savant.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Samuel 7:21
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Yu dey do all dis tins for mi yor savant, bikos na so Yu wont am. Yu don show mi how Yu big rish.


My God! Nor bi wi get di glory! Nor bi wi, but make all glory bi yor own, bikos of yor faithfulnes and love wey nor dey fail.


I bow kon woship Yu for yor holy temple. I dey praiz yor name, bikos of yor faithfulnes and love wey nor dey fail; bikos Yu don make yor promise and e high pass di sky.


God nor bi like man wey dey lie and E nor bi human being wey dey shange en mind. Anytin wey E promise, E dey do am; Anytin wey E tok, na so e go bi.


Heaven and eart go vanish, but my word go still dey.


E do dis tins to show en love for awa grand-grand papa dem and to remember di promise wey E give dem.


For dat time, di Holy Spirit kon make Jesus dey happy, so e kon sey, “I praiz yu, Papa wey bi Oga God for heaven and eart, bikos yu don hide dis tins from pipol wey get sense and wise, but yu show dem to yor shidren. Yes, Papa, na so yu wont make e bi.


“Make una nor fear, una wey bi small sheep, bikos una Papa go happy to give una di kingdom.


Na Paul, wey God koll to bi Jesus Christ apostle and Sostenes, awa broda, na dem rite dis leta.


E do like dis wen E show us di sekret plan wey E get and di good mind wey E show evribody, thru Christ.


Dis happen akordin to en plan wey go stand forever and E make am happen thru awa Oga God Jesus Christ


Make una dey good to one anoda; dey sorry for pipol and dey forgive each oda, just as God forgive una thru Christ.


Una nor dey enter and stay dis land, bikos una dey good or get sense. Di Oga una God go porshu dis pipol komot for una, bikos of di wikedness wey dem dey do and to fulfil di promise wey E make with una grand-grand papa, Abraham, Isaak and Jakob.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ