15 En and Israel pipol blow trumpet kon dey shaut as dem dey karry di box with happiness go Jerusalem.
David wey wear only linen for en waist, dance well-well to take honor God.
As dem bring di box kom di town, Mikal wey bi Saul girl pikin look from window and e si David as e dey dance well-well with only linen klot, di woman kon dey shame, bikos of David, en husband.
David still kommand Levi leaders sey, “Make Levi pipol use harp and cymbals take play music.”
So King David, Israel leaders and all di sojas oga, go Obed-Edom house go karry di Kovenant Box kom Jerusalem and dem kon dey sing and dance.
So evribody for Israel follow di Kovenant Box go rish Jerusalem dey happy, dey play trumpets, horns and cymbals kon dey sing and dance.
I go disgrace en enemies and David kingdom go rule forever.”
Make doz wey dey fear am, happy, bikos E go fight for dem! Make dem shaut for joy as dem dey sleep for dia bed!
Make wi praiz am with trumpet sound; make wi praiz am with jita and harp!
Evribody! Make una kom! Make una klap una hand! Make una shaut praiz God with klean mind!
Di prince go kom inside wen di pipol don kom and e go komot wen di pipol don go.
I go still dey happy and sing for joy, bikos na Oga God dey guide mi.