Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Samuel 5:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 King Hiram for Tyre kon send business men go meet David, e send cedar woods with karpenters and doz wey dey do stones go meet David make dem take build di palis.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Samuel 5:11
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So, David kon know sey God don make am king for Israel and E dey make en kingdom prosper, bikos of en pipol.


Den King David kon go stay en house. And God keep am save from en enemies.


One day, e koll Profet Natan kon sey, “I dey stay dis house wey dem build with cedar, but God Kovenant Box, dey for tent!”


Solomon still get 80,000 men for di mountin side wey dey kut stones and 70,000 men wey dey karry di stones.


So, King Solomon men, King Hiram men and di men from Gebal town kon make di stones and timba wey dem go take build di temple.


King Hiram for Tyre kon send message go give David sey make dem do business togeda. E still send cedar wood, stones and karpenters make dem take build one palis for David.


So di pipol give money to take pay doz wey dey mold block with di karpenters. Dem send food, drink and olive oil go Tyre and Sidon, so dat dem go give dem cedar trees from Lebanon. Dem karry di trees pass Joppa wotaside and na King Cyrus for Persia allow dem do all dis tins.


My God, I go praiz Yu, bikos Yu save mi and Yu nor let my enemies win mi.


“Man pikin, dis na wetin Tyre pipol dey tok about Jerusalem. Dem sey, ‘E get pawa before bikos of en money, but naw wey di town don skata, wi go get plenty money kon strong pass am!’


E turn face Rama plus di strong-strong towns for Tyre, den e turn face Hosah kon end for di sea near Hebel, Akzib,


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ