6 As David men and Saul men kontinue to dey fight, Abner kon popula and get pawa well-well for Saul pipol side.
Di fight between David and Saul family tey well-well. As David pipol dey strong evriday, Saul pipol kon dey weak more-more.
Itream, wey en mama name na Eglah. Dem born all dis shidren give David for Hebron.
Den Jehu and Rekab pikin, Jehonadab kon go di juju temple. Jehu tell di pipol, “Make una make sure sey nobody wey dey serve God dey here with una; bikos na only doz wey dey serve juju must dey here.”
Even if yu fight well for di war, God go make yor enemies win yu. Na only God get di pawa to help and fight for pesin.”
Yor wisdom, brain and undastandin nor mean anytin if God dey against yu.
“Anybody wey nor dey with mi, dey against mi and anybody wey nor join mi, dey skata my work.
Saul wife name na Ahinoam wey bi Ahimaaz pikin. Di oga for Saul sojas na Abner wey bi Ner pikin and Ner na Saul papa broda.