2 Samuel 3:35 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
35 For morning go rish evening for dat day, di pipol try taya make David for chop sometin, but David don promise sey, “Make God ponish mi, if I chop anytin today!”
Nor let pipol hear yu kry. Nor skrape yu head or waka with ordinary leg like sey yu dey mourn. Nor kover yor face or chop di kind food wey pipol wey dey mourn dey chop.”
Bikos dem don go Bethel go kry for God present till evening kon dey sey, “Make wi fight against awa rilative for Benjamin tribe again?” God ansa dem, “Make una go fight dem.”
Where yu for die, I go die for der too and na der dem go beri mi put. Make God ponish mi well-well if I nor do wetin I promise! Na only deat go fit separate mi from yu!”