Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Samuel 3:29 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

29 But make di ponishment fall for Joab and en family head! For evry generashon, make one man from en family sofa sickness like leprosy; bad skin diziz; dey waka with walkin stik, make e die for war or nor si food chop!”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Samuel 3:29
18 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

den David tell di dead man, “Na yu use yor mout take kill yorsef: Yu kondemn yorsef wen yu sey yu kill di pesin wey God choose as king.”


Yu take Saul kingdom and naw, God dey ponish yu for all di pipol wey yu kill for Saul family. God don give di kingdom to Absalom yor pikin. Yu don fall; yu wey dey kill pipol anyhow!”


Wen David hear wetin happen, e sey, “God know sey mi and my men hand nor dey Abner deat.


E get one man wey en name na Naaman and na-im bi Siria sojas oga. Siria king like and dey respet am well-well, bikos thru am, God don make Siria pipol win many war. Naaman sabi fight well-well, but e get one kind diziz for body.


Bikos of dis tin wey yu do so, Naaman diziz go katch yu and yor shidren-shidren forever.” So wen Gehazi komot from Elisha front, di diziz kon katch am and en body kon dey white like snow.


So, I go tank God, bikos E dey judge well; I go sing and praiz di Most High God.


and leta e kon stand up waka by ensef, den di pesin wey nak am, don dey innocent, but e go pay di pesin wey e wound all di time wey e don waste kon make sure sey en body strong.


“Make una go tell Israel pipol sey, ‘Wen man discharge, e go dey unklean, bikos of dat tin.


“ ‘If una do like dat, una go spoil di land where una dey stay. Di pesin wey kill pesin dey spoil di land and unless dem kill-am, dem nor go fit klean di land where dem for kill pesin.


Wen di pipol wey dey stay der si sey di snake put e mout for Paul hand, dem kon dey tell demsef, “E bi like sey dis man hand nor klean! Even doh e nor die inside sea, hand don still tosh am for here!”


Di eldas for dat town must wosh dia hand on-top di small melu wey dem don break en neck.


Bikos dis pipol kill yor pipol and profets, so yu don give dem blood make dem drink, bikos na wetin good for dem bi dat!”


Dis tin happen so dat, Abimelek and di men for Shekem wey enkourage am to kill Gideon 70 shidren, go sofa for wetin dem do.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ