Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Samuel 3:25 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

25 “Yu know sey, e kom here kon deceive yu and to know evritin wey yu dey do and anywhere wey yu dey go?”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Samuel 3:25
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

But Josef sey, “Na lie, una kon si if una go fit attack awa land.”


One pesin among una go-go bring una broda kom, while di rest of una go stay here. Like dis, wi go know weda una dey tok trut. If not, as long as Fero dey alive, all of una na tif!”


Den Josef remember di dream wey e dream about dem, so e tell dem, “Una bi tif! Una kon look weda una fit attack awa land!”


doz wey bi leaders for Ammon kon tell di king, “Yu tink sey na bikos of yor papa wey die naim make David send dis pipol kom? Wi bilive sey e send dem kom spy di land, so dat e go kom fight and win us leta!”


So Joab go meet di king kon tell am, “Wetin yu do so? Abner kom meet yu, why yu let am go like dat?”


Wen Joab leave David, e send messenja go koll Abner and dem bring am back from Sirah well, but David nor know anytin about am.


Wen Abner rish Hebron, Joab take am go di gate side like sey e won tok to am where nobody go hear, den e shuk Abner for belle. Na so e take kill Abner, bikos e kill Asahel wey bi en broda.


until e go kom take una go one land wey bi like una own. Land wey food and wine full, where bread and vineyard dey; betta land wey get olive tree and honey. Den una go live and e nor go kill una.’ “So make una nor listin to Hezekaya, bikos e dey deceive una wen e sey, ‘God go save us.’


God dey always protet mi both wen I go out and wen I dey kom back! E go protet mi naw and forever.


I know evritin about yu; di tins wey yu dey do, di place wey yu dey go and how yu dey plan against mi.


pesin wey go-go out before dem and kom back before dem and wey go lead dem, so dat God pipol nor go bi like sheep wey nor get who dey guide dem.”


Dem kon dey tok among demsef. Some sey, “Jesus na good pesin”, but odas sey, “E dey play pipol wayo.”


Den di Farisee pipol kon ask di sojas, “Abi, e don deceive una too?


Pesin wey dey judge odas nor get eskuse for wetin e dey do and e nor matter who en bi. Bikos wen yu judge odas and yu dey do di same tin wey dem dey do, yu dey kondemn yorsef.


Anywhere wey una go and anytin wey una dey do, God go bless am.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ