2 Samuel 3:14 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
14 David still send messenjas go meet Ish-Boshet sey, “Make yu give mi my wife Mikal back, bikos I pay one hundred Filistia pipol skin to take marry am.”
As dem bring di box kom di town, Mikal wey bi Saul girl pikin look from window and e si David as e dey dance well-well with only linen klot, di woman kon dey shame, bikos of David, en husband.
Dis na how dem take born Jesus Christ. Wen Mary en mama don ready to marry Josef, before dem bigin sleep togeda, Mary kon si sey e don get belle with Holy Spirit pawa.
Saul kon sey, “Dis na wetin una go tell David: ‘Di king nor wont money for di girl; di only tin wey e wont na hundred Filistia pipol skin, so dat e go pay en enemies back for di tins wey dem don kause.’ ” (Naw, Saul bilive sey David nor go survive dis one.)
den David with en men go fight kon kill two hundred Filistia pipol. David take dia skin go give Saul, so dat e go fit marry di king pikin. So Saul give en pikin Mikal to David make e marry.