13 David ansa, “Okay! I go make agriment with yu for one kondishon; yu must bring Mikal wey bi Saul dota, anytime wen yu dey kom meet mi.”
But Judah tell en papa sey, “Di oga for der really warn us sey, ‘Una nor go si my face unless una bring una broda.’
But yu tell yor savants sey, ‘If una yonga broda nor follow una kom, una nor go si my face again.’
But wi tell am, ‘Wi nor go fit go, unless awa yonga broda go follow us, bikos wi nor go fit si di man if e nor follow us.’
Abner kon send messenjas go meet David wey dey Hebron dat time sey, “Who go rule dis land? Make yu make agriment with mi and I go bring Israel pipol kom yor side.”
As dem bring di box enter di town, Saul dota, Mikal look thru window kon si David en husband dey dance anyhow, so e kon dey vex for am.