Wen dem rish di place where God tok about, Abraham kon build altar for der and e arrange di wood on-top. Den e tie Isaak hand and leg kon put am on-top di altar.
den e beri Saul and Jonatan bones for Saul papa, Kish, grave for Zela wey dey Benjamin aria and di pipol do evritin wey di king kommand. Afta evritin wey dem do, God kon ansa Israel pipol prayer.
So Gideon build one altar for der give God kon koll am, “Yahweh Shalom wey mean, ‘Na Oga God bi peace.’ ” Till today, di altar still dey for Ofrah wey bi Abiezer family land.