24 But di king ansa, “No! I nor go fit give di Oga my God, sakrifice wey I nor pay anytin for.” So e buy di farm and di melu for fifty silva koins.
“Okay my oga! I go sell both di field and di grave give yu. For my pipol front, I sell am give yu. Make yu go beri yor wife for der.”
kon tell Efron for dia front sey, “Abeg, make una listin to mi. I go pay yu di prize for di field. Take am from mi, so dat I go fit go beri my wife for der.”
Abraham agri with Efron prize, e give di money to am kon dey tok make evribody for hear am, “Dis na 400 silva, just as dem dey measure am dat time.”
Naw, Devil won bring trobol kom meet Israel pipol, so e kon make David kount di pipol.
So David sey, “Na dis place di Oga awa God Temple go dey. Na for here Israel pipol go for dey burn dia ofrin give God.”
Make una nor pay evil for evil, but make sure sey wetin una dey do, good for God and pipol eye