Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Samuel 22:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 Wen I dey trobol, I koll Oga God; I koll my God make E help mi. E hear my vois for en temple kon listin and help mi wen I dey kry.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Samuel 22:7
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

so dem kry as dem dey trobol sey, “Awa God, make Yu kom help us!” So God save dem from dia trobol.


So I koll God name: “Oga God, abeg make Yu kom save mi!”


Wen I dey face trobol, I kry to God and E ansa my prayer.


But inside my trobol, I kry to God. Yes! I pray to my God make E kom help mi and E hear mi from en temple, bikos my kry rish en ear.


Na only one tin I ask from God and dat na wetin I wont! Na make I stay for God house forever, so dat I go dey si en mighty works kon always dey happy for inside en temple.


I pray to God as I dey sofa and E ansa mi; E save mi from evritin wey dey worry mi.


God kon tell am, “True-true, I don si how my pipol dey sofa for Egypt. I don hear dia kry for help and I know how dia sofa big rish.


Den I sey, ‘Oga God, Yu don drive mi komot from yor present kpata-kpata and I nor go ever si yor holy temple again!’


Wen I tink sey my life don dey finish, I kon pray give Yu and Yu hear mi from yor holy temple.


But Oga God dey en holy temple, so make evribody for di world, keep kwayet for en present.”


Bikos Jesus dey struggol well-well for mind, e pray sotey en sweat kon bi like blood.


Wen Jesus still dey dis eart, e pray and kry to God wey go save am from deat. God hear en prayers, bikos e obey God for evritin.


Si, di money wey yu nor gri pay di workers wey dey work for yor farm, dey kry against yu and di pipol wey dey gada wetin yu plant, dia kry don rish God ear.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ