David wey bi Jesse pikin, na God make am great well-well. Na dis pesin, Jakob God choose as king and na-im rite betta songs for Israel pipol. Dis na di last words wey David tok:
So dis na wetin I tok about God: “Na only en bi di place where I dey hide put, where wiked pipol nor go for fit tosh mi; na-im bi my God and I trust am well-well.”
Di sevent angel blow en trumpet and one loud vois kon shaut from heaven: “All di kingdom for di world don bi God and Christ own. E go rule forever and ever.”