49 My Oga God! Yu save mi from my enemies kon give mi viktory and protet mi from wiked men.
Den di Sudan savant kom tell di king, “I get good news for my king! God don give yu viktory against all di pipol wey dey fight yu!”
So, David kon know sey God don make am king for Israel and E dey make en kingdom prosper, bikos of en pipol.
My God, make Yu save mi from wiked pipol! Protet mi from pipol wey like wahala;
My God, nor let mi fall enter wiked pipol hand. Make Yu protet mi from doz wey like wahala, bikos dem dey plan bad against mi.
kon save mi from my enemies. E keep mi for where my enemies nor go for fit tosh mi kon save mi from wiked pipol.
Na yor pawa wi go take porshu awa enemies; na yor name wi dey take mash dem for groun.
Yu wey tink sey yu strong, why yu dey karry body for di bad tins wey yu dey do? Yu nor know sey God love dey always protet mi?
Dem go get enough rain and dia shidren-shidren go plenty like river; dia kings go get pawa pass Agag and pipol go praiz dia kingdom.
E dey karry weak pipol komot from san-san and dey make poor pipol sidan with prince and princess kon put dem for where pipol go honor dem. Di foundashon wey di eart sidan put, na God get am; na on-top am E build di world.