“Man pikin, tell dis men wetin God wey get pawa dey tok: Una don kom ask wetin I wont, abi? As long as I bi di God wey dey alive, I nor go let una ask mi anytin. Mi, wey bi God wey get pawa, don tok.
But wen una dey trobol, una go kom beg God make E help una! Una dey espect sey God go ansa una? Afta all di wiked tins wey una don do, God nor go even look una face!”