36 My Oga God! Yu protet and save mi; Yu don make mi great.
“Den I go turn yu to one strong kountry kon bless yu. Yor name go dey great and yu go get betta blessing.
Afta all dis tins, God tok to Abram for vishon: “Abram! Make yu nor fear! Na mi dey guide yu and yor reward go big well-well.”
I go really bless yu kon make yor shidren-shidren plenty well-well and nobody go fit kount dem, just as nobody fit kount stars for sky or di san-san wey dey near river. Yor shidren-shidren go take all di tins wey bilong to dia enemies.
Make God really make una plenty; both una and una shidren.
My God, Yu don give mi wetin go protet mi. Yor rite hand dey support mi and I don dey strong, bikos of di way wey Yu dey help mi.
Oga God na awa sun and naim dey protet us. God dey give us grace and glory and E go always dey good to doz wey dey do good.
and with all dis, make una karry faith wey go help una kwensh all di wiked arrows wey Satan dey trow.
Make una wear salvashon like priest kap for head kon whole di Spirit swod wey bi God word.