God wey dey rule and protet Israel pipol; di Pesin wey get pawa sey, “Na mi bi di First and di Last; e nor get any oda god apart from mi wey bi di Almighty God.
So my pipol, make una nor fear or shake! Una know sey from biginnin kon rish naw, I always dey tok di tins wey go happen and una bi my witness. E get any oda god apart from mi? E nor get any oda god, wey get pawa. I neva si or hear about any one?
So make una kom tok una kase; make una judge for unasef! Who don fit tok sometin and e happen? Nor bi mi bi God wey dey save pipol? No oda god dey apart from mi wey bi God and wey dey save una.
God sey, “Na Mi, bi Mi! And e nor get any oda god escept Mi. I dey kill and give life, I dey make pesin sick and heal pesin too and nobody go fit fight mi.