But Abishai, Zeruaya son, run kom help David attack di giant kon kill-am. Den David men kon sey make David promise dem sey e nor go follow dem go fight war again. Dem sey, “Na yu bi di hope wey Israel get and wi nor won luz yu.”
but I go let Solomon pikin keep one tribe, so dat my savant David, shidren-shidren go fit dey rule for Jerusalem, di town wey I don choose sey dem go for woship mi.
All of una wey dey respet God and obey en savant words, di road wey una dey waka fit dey dark, but make una trust una Oga God! Make una put hope for una God.
I go dey patient as God dey ponish mi, bikos I don sin against am. But afta E don ponish mi, E go fight for mi kon make mi win. God go take mi enter di lite and I go si en raitiousness.
But for una wey dey fear my name, my sun wey dey give life go shine and heal una. Una go dey free kon dey happy like melu pikin wey dem open en kage make e for go play.