25 So E reward mi, bikos I dey do wetin dey rite, bikos E know sey I dey innocent.
God reward mi, bikos I do wetin dey rite. E bless mi, bikos I dey innocent.
Solomon ansa, “Yu show great love to David my papa wey bi yor savant and e dey good, dey respet and always dey honor Yu. Yu still show am yor great love wey nor dey end, wen Yu make one of en pikin king afta am.
Doz wey good, dey get dia reward for dis world, but na ponishment go follow pipol wey dey sin and do wiked tins.
God dey si evritin wey yu dey do and E know evriwhere wey yu dey go.
So make una tell innocent pipol sey e go betta for dem, bikos God go reward dem for wetin dem don do.
Bikos all of us must stand for Christ front and e go judge us akordin to di tins wey wi do wen wi dey dis eart; weda dem good or bad.
“God dey reward doz wey dey honest and raitious. Even doh today God put yu for my hand, I nor go ever kill di pesin wey God use en own hand choose.