23 I don keep all en laws; I neva disobey en kommand.
I neva sin against yor laws, bikos Yu tish mi well.
All yor kommands dey korrect and dat na di rizin why I hate to do bad tins.
I dey shaut and tok about all di kommands wey Yu give us.
I don choose to follow Yu; I don gri to live my life as yor word tok.
den I nor go shame, bikos I dey follow wetin Yu tok.
But all yor kommand dey good, so make Yu protet mi from di pipol wey just like to kill mi.
Dem dey do wetin God like, dey follow all di tins wey God tok for en word.
Una go bi my friend if una do wetin I tok.
As e dey read am evriday, e nor go dey proud and e nor go do like sey e important pass evribody. Dis nor go let am turn from dis kommand at-all. And e go make en and en shidren-shidren reign as king for Israel forever.
If una listin to dis rules kon obey dem with all una heart, di Oga una God go really keep en kovenant wey E promise una grand-grand papa.
Make una make sure sey una nor forget di Oga una God. Make una dey keep en kommand and law wey I dey give una today.