16 Di river dry finish and di eart foundashon kon open so God nor keep silent and E kon shaut for en enemies with vexnashon.
Smoke dey kom out from en nose, while fire and shako dey kom out from en mout.
I tell am sey, ‘Na here yu go rish and yu nor go pass der! Na here yor pawaful wave go for stop.’
E kommand di Red Sea make e dry kon take Israel pipol cross am like sey na desert
My God, wetin make Yu rijet us forever? Wetin make Yu dey vex for yor own sheep wey dey yor field?
Naw, make di mountins listin to God! E get kase against en pipol. E go tok wetin Israel pipol do.
God kommand di river and e kon dry wons; E make all di river dry rish groun. E distroy Bashan and Karmel land and all di trees for Lebanon, dry finish.