Wen David bi king, strong honga kon dey and e last for three years. So David ask God and E ansa am sey, “Saul and en family dey guilty, bikos dem kill pipol. Dem kill Gibeon pipol.”
So make yu give us seven of en grand sons and wi go hang dem give God for Gibeah, wey bi Saul, di king wey God choose town.” Di king ansa, “I go give una.”
“ ‘Afta di sixty-two weeks, di Pesin wey God choose, go die and nor-tin go remain. Di ruler wey get pawa pass, go bring sojas kom distroy di town and di temple. Di end go rush kom like wota; e go bring war and distroshon, just as God plan am.