Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Samuel 21:17 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

17 But Abishai, Zeruaya son, run kom help David attack di giant kon kill-am. Den David men kon sey make David promise dem sey e nor go follow dem go fight war again. Dem sey, “Na yu bi di hope wey Israel get and wi nor won luz yu.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Samuel 21:17
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

And naw, my rilashons sey make I give dem my pikin wey remain, so dat dem go kill-am, bikos e kill en broda. If dem do like dis, I nor go get pikin again. Dem go distroy my last hope and nobody go dey again to ansa my husband name.”


E divide dem into three groups kon send dem out. Na Joab, Abishai wey bi Joab broda and Ittai wey kom from Gat, dey kommand each group. Di king tell en men, “I go follow una go.”


But dem ansa. “Yu nor go follow us, bikos e nor go mean anytin to di enemy if wi wey remain turn and run or even if dem kill half of us, but only yu bi like 10,000 of us. E go betta make yu stay here dey send help kom give us.”


Wen I dey trobol, dem attack mi, but God protet mi.


Oga God! Na Yu bi my lite; Yu don remove my darkness.


but I go let Solomon pikin keep one tribe, so dat my savant David, shidren-shidren go fit dey rule for Jerusalem, di town wey I don choose sey dem go for woship mi.


But bikos of David, Oga God kon give Abijah one son wey go rule Jerusalem afta am.


For der, I go make David pawa strong; bikos I don decide sey, en shidren-shidren go bi king forever.


Bikos Yu don give yor kings viktory kon save yor savant David from en enemies swod.


Na God bi di strong place wey wi dey hide put and na-im dey help us wen wi dey trobol.


Den Johanan koll am go korna kon sey, “Make I go kill Ishmael and nobody go know who do am. If not, e go kill yu and dat kind tin go skata Jew pipol wey gada round yu and e go kause wahala for evribody wey remain for Judah.”


John lite shine well-well for small time and una happy wen una si en lite.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ