For di fourteent year, Kedorlaoma and di kings wey join togeda kon go win Refah pipol for Ashterot-Karnaim, Zuz pipol for Ham, Emite pipol for Shaveh Kiriataim
Before-before and even leta, Nefilim pipol (giant pipol) dey for di eart and na God sons born dem wen dem dey sleep with ordinary wimen. Na dem bi di wariors wey pipol bin know for evriwhere.
Wen dem pass thru Negev, dem kon rish Hebron for Ahiman, Sheshai and Talmai, where Anak shidren-shidren dey stay. (Naw, dem don build Hebron seven years before dem build Zoan for Egypt.)
Na wetin go happen to us? Awa own brodas don make us dey fear, bikos dem sey, ‘Di pipol wey dey di land big well-well pass us; dia kountry dey big and dem fence am rish heaven. Wi still si Anak shidren-shidren for der too.’ ”
For all Refah pipol, na only King Og for Bashan remain. (Na iron dem take make en bed and e still dey for Rabbah wey dey Ammon. Akordin to how dem dey measure, di bed long rish thirteen and half fit and e wide rish six fit.)