Den Saul girl-friend, Rizpah, wey Aiaya born kon use sak klot take make house for ensef for where di dead body dem dey and e stay der from harvest time go rish wen heavy rain start to fall. E go drive birds komot from di dead body for day time kon keep dem from bad animal for nite.