32 Dem take Asahel body kon go beri am for en papa grave for Betlehem. Den Joab and en men travel for dat nite and dem kon rish Hebron di next day.
Di time wey Israel won die kon rish, so e koll en pikin Josef kon tell am, “If really sey yu love mi, make yu put yor hand under my lap kon show mi kindness and faithfulnes. Make yu nor beri mi for Egypt,
but wen I die, karry mi komot from Egypt go beri for my papa burial groun.” So Josef sey, “Papa! I go do as yu tok.”
David men kill three hundred and sixty among Abner men wey kom from Benjamin tribe.
Den all di tribes go meet David for Hebron kon tell am, “Wi bi yor own flesh and blood.
Dem beri am for en own grave for David Town. Dem pour spices and betta oil for en body kon make and burn big fire to take honor am.
Jehoshafat die and dem beri am with en grand-grand papa dem for David Town. En pikin Jehoram kon take-ova as king.
Yu don si pesin wey get good work? E dey-dey with kings and nor bi with yeye pipol.
Gideon, Joash pikin, old well-well before e die and dem beri am for en papa Joash grave, for Ofrah wey dey Abiezer town.
Saul ask am, “My pikin! Na wish pesin pikin yu bi? Who bi yor papa?” David ansa, “Jesse wey bi yor savant wey kom from Betlehem, naim bi my papa.”